Wia dis foto come from, Andrew Harnik/Getty Images
Di Trump administration dey offer unaccompanied migrant children $2,500 to voluntarily comot from di United States, according to one letter wey dem send to migrant shelters, wey Reuters see.
Officials of Immigration and Customs Enforcement (Ice) under di Department of Homeland Security (DHS) confam say monetary offer dey ground but e no specify di amount, Reuters report.
Di move na di latest financial offer wey di DHS dey make under President Donald Trump – wey aim to encourage voluntary deportations.
For June, di State Department bin move $250 million to DHS for voluntary deportations and di administration bin offer $1,000 stipend to migrants wey “deport diasefs”.

